After small break wey feel like forever, ambitious Shooting Stars don return home.
And this time, na serious business.
The Oluyole Warriors continue their NPFL 2026 campaign this Sunday as dem host fellow continental chasers, Nasarawa United—aka the Solid Miners, for Lekan Salami Stadium.
Make we no lie, last Sunday still dey pain small.
That Oyo State FA Cup final loss to Crown FC? Osho Fatai boys carry us go penalty shootout come humble us… everywhere scatter, fans vex, vibes drop
But as dem dey talk am,
“wetin don happen don happen.”
Cup don go…
League still dey.
Now we don return to our own territory, Lekan Salami Stadium. And if there’s one thing we sabi this season, na this:
When 3SC play for home,
dem dey:
Na like say dem plug charger enter their system
So yes… another home win? Very possible.
Nasarawa United no be pushovers.
Dem dey chase continental slot too, so no team dey come Ibadan come joke.
But… big blow for them, Benjamin Oloche no go feature. That one na one very big serious minus.
Their coach, Mbwas Mangut, get history with us. Last time him come Ibadan (during his Plateau United days), na stalemate we play.
So question be, him go come for revenge… or repeat the same story?
Good news for us:
This combo alone fit change the whole tempo of the game.
Nasarawa go come say: “We dey mine points anywhere.”
We go reply: “Ibadan no be quarry site… no mining allowed here.”
After FA Cup heartbreak,
this na perfect chance to reset and bounce back.
Shooting Stars fans, make we ginger ourselves.
This one:
IBADAN! E DIDE!
Because Sunday no be for story…
Na for response.
Mbwas Mangut x Ya Nuru… make we see who go smile last