All eyes don shift to Sunday as we return home to face Kwara United in another spicy NPFL 2025/2026 fixture.
This one? Lekan Salami Stadium go full. No space. No breathing room.
From Gere Alimi to Tanke, Ita Merin to Arabambi, everybody go show. Even people wey dem don send comot from their area go still find way enter stadium because this fixture no be the one you hear result for radio… you gats witness am live.
And make we remind them small…
Kwara United never beat us for Ibadan.
Na here dem dey always collect change.
Kwara United, current Nigeria Federation Cup champions, dey seriously battle survival, ko kan’ye.
From representing Nigeria in CAF competition this season to sitting 18th on the table with 39 points now, omo, football humbles.
Yes, dem just beat El-Kanemi 3–0 last weekend, but make dem calm down small… Ibadan no be Maiduguri.
Their coach, Ashifat Sulaiman (wey some people don nickname “Brazil from Temu”), talk say dem go fight like wounded lion.
Lion ke? For Ibadan?
Where warriors like Balogun Oderinlo and Aare Latoosa spirit still dey guide us?
Make dem no wound themselves finish before halftime.
We go give them small respect sha:
Set pieces na their major weapo, Yahaya Ibrahim dangerous for air
But all these plans… na if we allow them breathe.
This one no be just match, na redemption mission.
Shooting Stars dey come fully motivated, back against the wall, eyes on maximum points.
Good news?
Ayobami Junior is back.
And we all know wetin that means, creativity unlocked.
Midfield balance don improve, especially with better aerial duels, one area wey disturb us earlier this season.
Defensively, expect Desmond Ojietefian to lead again alongside the ever-reliable Tijani Al-Ameen, experience pelu composure.
Kwara dey fight relegation.
We dey protect our home and chase bigger dreams.
Simple math.
Dem fit come with ginger, talk say dem be wounded lion…
But na Ibadan be the jungle wey no dey pity visitor.
So as you dey come stadium:
Chop well
Go asalatu pray
Wear your blue and white with pride
Because this Sunday… we no dey negotiate.
Na to dominate.
Na to collect.
Na to remind them say Ibadan no be anybody mate.
Come early, get your ticket, no last-minute rush.
And for Kwara United…
Iku pa yin.
(In football terms.)