OYO FA CUP FINAL PREVIEW: SHOOTING STARS vs CROWN FC
Ayo Hameed
AJILETE vs OLUYOLE, WHO GO CARRY AM?
Ahhh… Customer Dadani Crown FC, the team wey survive relegation for NNL through fasting and prayer ministry don show again!
Now dem don find themselves face-to-face with Shooting Stars, as both sides go clash for the Oyo State FA Cup final… (and if you ask fans, this fixture don happen like 1433 times already)
ROAD TO FINAL
OMO WEYREY BUSINESS AS USUAL
3SC, the Egbon adugbo, secure their Nigeria Federation Cup ticket after handling their own academy side “New Taker” with a slim 1-0 win some people talk say na “arumoje goal” but goal na goal.
Goal courtesy of Alade Balogun Idan, no too much noise, just job done.
Senior men remind the academy boys say: “Respect your elders first before anything.” Even though the Academy boys dey ball oh, chai
AJILETE WARRIORS NO COME PLAY
On their own side, Crown FC, under Osho Fatai, no dull at all. Dem knock out Ibadan United 2-0: Former 3SC boy, Odeyemi Ebenezer, open scoring (you sabi say ex-player dey always get something to prove) and Rilwan Sodiq seal am from the spot
Now dem don secure their own Federation Cup slot and dey eye this trophy like say na gold medal.
FINAL SHOWDOWN
So na this Sunday:
Oluyole Warriors vs Ajilete Warriors Ibadan vs Ogbomoso Big brother vs stubborn younger one
E go sup… no be small.
Crown go bring their prayer, discipline, and small stubbornness. 3SC go bring experience, depth, and that “we don see this thing before” confidence.
FINAL WORD
Crown fans go say:
“Na our time be this!”
3SC fans go reply:
“Relax… make elders handle trophy first.”
But make we no lie, Cup final no dey respect history.
Na who show hunger pass go carry am.
Come watch, come enjoy, come argue!
Because this one no be match you go hear result from roadside gist.