MATCH PREVIEW

EL-KANEMI WARRIORS vs SHOOTING STARS – CONTINENTAL DREAM OR JUST CRUISE?

Ayo Hameed

So the big question be this…

Will 3SC resurrect their continental hopes this weekend… or we go still dey press calculator?
We dey enter Matchday 35 of the NPFL, and this time na long trip to Maiduguri to face El-Kanemi Warriors, the real Desert Warriors.

MAIDUGURI NO BE MOLETE

Make we no sugarcoat am…
El-Kanemi for home this season?

Different beast.
• 12 wins
• 5 draws
• Zero fear

If you enter Maiduguri anyhow, na you go carry your L go back.
Kabiru Dogo boys dey sit 11th with 46 points, no pressure, no panic. Dem no dey fight relegation, dem no dey chase continent… na that kind team wey fit spoil person’s plan for fun.
And make we no forget, Daddy Abdurrahman Abdullahi (former 3SC boy) dey wait us.
You know say ex-player + motivation = potential wahala

OMO WEYREY – BAALU MODE ACTIVATED

Now to our own…

WNDC don enter BAALU MODE. Continental chasers, no retreat.

Coach Aweroro Nurudeen aka “Idowu Berger” don already drop hint say Sunday go loud. And to be fair, our recent results for Maiduguri no too bad, we fit use that one take ginger.

But… big miss, Ayobami Junior no dey available. Best playmaker for the league missing? That one na serious hole.

So na midfield trio of: Tijani Kabiru, Stephen Chukwudi and Stephen Amos (Mr. Consistency himself) go carry the load.

GOALS NEEDED… NO STORY

Sodiq Ibrahim, fresh from winning NPFL Goal of the Month (March), dey chase something personal: First-ever double digits in NPFL. This one no be just about club now…na legacy + numbers.

LAST TIME OUT…

Last time we visit Maiduguri? 2-2 draw. We show say we fit score there… but we also show say we fit concede nonsense.

So question be, which 3SC go show on Sunday?

OFF THE PITCH VIBES

Special shoutout to Tobi Ajagungbade and Idrissi Hypeman, first time trip to Maiduguri.

Omo… EYIN OMO OGO, E BAMI MU 3 POINT BOOOOO No be sightseeing we send una go o!

FINAL WORD 

El-Kanemi go say: “This na our territory.”
We go reply: “We no come greet anybody, we come collect something.”
But truth be told, if we no serious, desert go humble us.

IBADAN! OYO STATE! E GBA ADURA

Because at this stage… Continental football still possible. But na only if we stop doing “almost” and start doing complete job.

Up Shooting Stars. Always

3SC FANS TV © 2025 All rights reserved

0
    0
    Your Cart
    Your cart is emptyReturn to Shop
    Scroll to Top