MATCH PREVIEW

SHOOTING STARS vs NASARAWA UNITED – BACK TO BUSINESS AT HOME

Ayo Hameed

After small break wey feel like forever, ambitious Shooting Stars don return home.

And this time, na serious business.

The Oluyole Warriors continue their NPFL 2026 campaign this Sunday as dem host fellow continental chasers, Nasarawa United—aka the Solid Miners, for Lekan Salami Stadium.

FROM PENALTY PAIN… TO LEAGUE FOCUS

Make we no lie, last Sunday still dey pain small.

That Oyo State FA Cup final loss to Crown FC? Osho Fatai boys carry us go penalty shootout come humble us… everywhere scatter, fans vex, vibes drop

But as dem dey talk am,
“wetin don happen don happen.”

Cup don go…
League still dey.

HOME ADVANTAGE – OUR SAFE ZONE

Now we don return to our own territory, Lekan Salami Stadium. And if there’s one thing we sabi this season, na this:

When 3SC play for home,
dem dey:

  • More organized
  • More disciplined
  • More confident

Na like say dem plug charger enter their system

So yes… another home win? Very possible.

SOLID MINERS UPDATE

Nasarawa United no be pushovers.

Dem dey chase continental slot too, so no team dey come Ibadan come joke.

But… big blow for them, Benjamin Oloche no go feature. That one na one very big serious minus.

Their coach, Mbwas Mangut, get history with us. Last time him come Ibadan (during his Plateau United days), na stalemate we play.

So question be, him go come for revenge… or repeat the same story?

OMO WEYREY LINE-UP BOOST

Good news for us:

  • Stephen Amos is back
    (rested last game, but now ready to run midfield again—guy don turn automatic starter, no debate)
  • Ayobami Junior fit return
    (and we all know wetin creativity like that means)

This combo alone fit change the whole tempo of the game.

FINAL WORD (BANter MODE)

Nasarawa go come say: “We dey mine points anywhere.”

We go reply: “Ibadan no be quarry site… no mining allowed here.”

After FA Cup heartbreak,
this na perfect chance to reset and bounce back.

Shooting Stars fans, make we ginger ourselves.

This one:

  • Winnable
  • Important
  • Statement match

IBADAN! E DIDE!

Because Sunday no be for story…

Na for response.

Mbwas Mangut x Ya Nuru… make we see who go smile last

3SC FANS TV © 2025 All rights reserved

0
    0
    Your Cart
    Your cart is emptyReturn to Shop
    Scroll to Top